Letras Web

NEPA

Chiido

6 acessos

Verse 1
Nepa, na lie you don start again, every night around 8pm
I don pay my last bill with the money i suppose
Go use buy garri for my sunday night meal
See me no money to buy some kerosine
No battery for my touch light
I dey go malaam for credit
Aboki won use im horse whip
Trash me for back i con run go the streets ehh
Okada man wait, abeg stop make you carry me go mushin
I dey go nepa office
Me and them go fight today
I dey vex like that pikin don pour me pepper spray
God help them if dem never bring my light by the time i con reach my house
When you watch football [dem take light]
Thriller [dem take light]
Comedy [dem take light]
Music [dem take light]

Chorus 4x
Nepa bring back my light bring back my light
I don tire o

Verse 2
I don reach nepa office
For desk receptionist jus they give me long tory
Where the man in charge chei una they find serious trouble
Abi you don forget say me i dey hussle as i dey now
Hunger they wire me
Sote i fit eat a horse that one na metaphor
Jokes apart biko wey my light
I go scatter the paper for your table
I dey talk you, ma dey sit their dey watch cable
My situation dey very unstable, oga you dey hear me so
Oh boy, shutup abi na only your light wey nepa take
If i land you one you gon shake like olumorock
Wey king kong scatter, you dey think say because i dey skinny
I no go fit batter
You and your colleagues na thief una be, ole barawo
You don fap my light fee wey my light

Repeat Chorus

Verse 3 [Ay]
Na any time nepa fit touch light
Reason people hold on to touch light
Wahala start wen i start to touch light
Food money dem go take am buy candles
People carry lantern and okada carry bike handles
Candle wax plenty on top table
Like channel on top cable
Darkness nepa na clothes and liod in turn tables
Dem dey make people uncomfortable
Na waa i dey here dey form syllables
And rap about light, electricity na part of our lives
Situation still dey highlight
Facts about light
When light come people be like up nepa when dem mean
Frock nepa cause dey take light and leave hot tempers in block letters
You no fit dey your room like penpals
Generator necessary inside house like ink in pen pal

Repeat Chorus 4x

Top Letras de Chiido

  1. Shake body
  2. NEPA
  3. Pidgin English